Jump to content

Saudan Kaduna pipul-waipin

From Wikipedia
Saudan Kaduna pipul-waipin
genocide
KontriNaija Chenj-am
LocationSaudan Kaduna Chenj-am
Wen e stat2011 Chenj-am
Wen e end2023 Chenj-am

Wetin bi kos di waipin kilikili of di Saudan Kaduna pipul espeshali for di 2010s an eli 2020s fit tres rish di waka abaut wey kari Goodluck Jonathan bikom President of Nigeria for yie 2010, di kilikiki kom stil kom rampant afta di presidensha elekshon for 2011, wey im win.[1]

How e tek stat

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pesin fit rememba for di 2011 Naija presidensha elekshon kampen wey dem show for nashonal TV, NTA, wey di Congress for Progressive Change (CPC) kandidet, Muhammadu Buhari wey bin dey yan giv plenti-plenti pipul for one nodan stet wey dem dey kol Kano for Hausa langwej, say mek dem komot skata di ples, di pipul kom dey hapi dey hail am. Na di exat ting wey im tok bi dis wey TheCable grab so,

"Ku fita ku yi zabe. Ku Kasa, ku tsare, ku raka ku tsaya. Duk wanda bai yarda ba, ku halaka shi."

Dem translate wetin im tok for di vidio for skrin laik dis:

"Fes-fes, na must say una go rejista, komot an vote. Una go gaid, protet, eskot [di elekshon ofisa-dem] go di koleshon senta, una go kom wait til dem kaunt di rezolt. Eni gbaga wey stop una, kpai am!"

Even say Buhari sopota-dem bin komot dey tok say wetin im tok na anoda ting im mean, pipul use dem eye tek si wetin im tru-tru mean afta di elekshon wey Jonathan win am ontop.[2][3]

Wie dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. Point go mistek: Invalid <ref> tag; no text was provided for refs named RW
  2. Yusuff, Sodiq (December 31, 2014). "Did Buhari really ask his supporters to 'kill' in this 2011 campaign video?". TheCable. Retrieved March 28, 2024.
  3. Aliyu U. Tilde (May 20, 2012). "Buhari vs. PDP: The dog and the baboon parable". Premium Times Nigeria. Retrieved March 28, 2024.